Sabi the koko wey dey inside web development

Sabi the koko wey dey inside web development

For my forma tori, I yan wetin programming and programming language be, (if you neva read am, e go good make you read am), for Inside e get programming language dem wey I mention, inside am I still yan say before you go sabi programming language wey you go learn, you go first sabi wetin you wan do or wetin you wan build, Weda na website, abi na game, na wen you don sabi wetin you wan do, na that time you go sabi programming language wey you go learn.

So for today tori, I wan kari you enter one area for programming, wey dem dey call "web development".

Wetin be web development?

Web Development na how dem take dey build new website or repair old one, but wetin be website? Website na wetin you sabi, some people sef dey enter plenty website for one day, wetin this website really be?

Wetin be website

Website be like book, e get wetin dem dey call pages, but wetin make book and website dey different be say, you fit hold book for hand but you no fit hold website for hand, website get where e dey live wey dem dey call internet.

But how person go fit take enter this website?

You know say I tell you say website dey live for internet abi? Ehen, Internet be like estate, all the house inside the estate get their own address, na so the thing be for internet, website dey inside internet and every website get their own address wey you fit use enter there, but wetin dem dey call am na domain.

Make I use Facebook take give example, you know say when you wan go Facebook, you go type facebook.com, that facebook.com na em dem dey call domain, every website get em own. So when that facebook.com don load, wetin you dey see na em be website.

Now wey you don know wetin website be, make we waka enter next level wey be why e good make you sabi web development.

Why make you sabi web development?

E get plenty reason why e good make you sabi web development, I don mention some for my forma tori but I go still mention some for here.

  • Money dey inside well well.
  • You fit do am anywhere anytime.
  • You fit get work for any country, even if you no comot for your country.
  • You fit use am as side hustle join work wey you dey do.
  • You fit become oga of your own.

plenty plenty other reasons dey.

Now wey you don know why e good make you sabi web development, make we talk wetin you go need to take start.

Wetin you need to start web development

Before you go waka enta web development, e get things wey you go need.

  1. Computer (e fit be laptop or desktop).
  2. Beta network.
  3. Browser ( e fit be chrome or anyone wey you like, but me I like chrome)
  4. Text Editor or Code editor ( e fit be VSCode, sublime, atom or anyone wey you like).

Now wey you don sabi wetin you need, make I tell you why you go need dem.

  • Computer: na this one be the koko, why you need computer be say web development no be wetin you fit do with phone.
  • Beta metwork: why you need beta network be say, as you dey work you go need download some things, if your network no good, e go give you wahala.
  • Browser: this one na em you go take see wetin you dey do, take see as the thing be.
  • Text Editor or Code Editor: na this one you go take write your code, na here you go write wetin you go see for your Browser, plenty editor dey, but the one wey plenty people dey use now na the one wey dem call VScode, the VS wey dey there mean Visual Studio, na this one mesef dey use.

So now wey you don know wetin web development be, why e good make you sabi am and wetin you need to start am, make we talk the languages wey dem take dey build website.

E get 3 koko things wey dem take dey build website, one na markup language, one na styling language, the oda one na programming language.

  1. HTML wey be Hypertext markup language.
  2. CSS wey be Cascading stylesheet.
  3. Javascript.

Make I explain dem for you.

  • HTML: This one na the foundation, you no fit build website make this one no dey there, this one no be programming language na markup language dem dey call am.

Make I use house give you example, you know say when dem wan build house, dem go first use block do am reach up, if e don reach when dem go roof am, dem go come put plank on top, ( see this photo wey dey down)

uncompleted building

Na so HTML be, as you no fit build house make you no use block, na so you no fit build website make you no use HTML.

Now, wey you don know wetin HTML be, make we talk the oda one wey be CSS.

  • CSS: you know say when dem don use block build house finish, e no dey fine, e go need make dem plaster am, make dem roof am ( see this photo wey dey down).

a bungalow

Na CSS work be that, e own na make the website fine for eye.

  • Javascript: this one na the oga kpata kpata for inside website,

    Sha know say Javascript with Java no be the same, some people dey confuse two of dem.

So as I dey talk, Javascript na em dey make you fit press something for website anoda thing go show.

Make I still use house take give example, you know for house you fit press switch make light on, you fit press am again make the light off.

Na so Javascript sef be for website, na em dey make things change, na em dey make am e be say if you press button something go show, if you press am again or if you press anoda button , the thing go comot.

Lass Lass

So for today tori, I don yan you wetin dey inside web development and how e take dey work.

if e get wetin you wan make I yan, put am for comment make I know.