Wetin be programming and programming language?

Wetin be programming and programming language?

Wetin be programming?

Programming na wen we dey give computer something make e do, as the world dey now, na programming dey for everything wey we dey use, awa phone, TV, radio, motor, even some okada, na computer dem dey use, But na how we go take tell computer wetin to do? Na there programming language for enter the mata,

Wetin be programming language?

For up, I tell you say programming "na wen we dey give computer something make e do", So, programming language na "how we take dey talk to computer", as human being get e own language like (English, Hausa, Youruba, Igbo, etc) na so computer sef get e own. Some programming language wey people know well well, na

  • C
  • C++ (Cplus-plus)
  • C# (Csharp)
  • Javascript
  • Python ( no be snake ooo).
  • Ruby
  • Java
  • PHP. De list many, so I no go mention them finish.

U fit dey wonda how dis programming language take dey work sef? I go explain am for u.

Na how programming language take dey work?

Computer no dey understand ABCD123 like we wey be human being, only wetin e know na 0 and 1, e shock u abi? But na true, na wetin make people wey know book well well come do wetin dem call "programming language", wetin programming language dey do be say, e go let we wey be human being write "program" wey human being go fit read and computer sef go fit understand am, remember say I tell you say computer no dey understand ABCD123 abi? Ehen, na where wetin dem dey call "compiler" for enter dis mata be dat.

Wetin be compiler?

Make I use person take dey give you example, For olden days wey everybody no dey hear English, if oyibo man come awa land, ( make I use Igbo land take give example), na person wey sabi igbo and oyibo language na him go dey tell the oyibo man wetin dem talk for Igbo, if dem say "bia" d person go tell d oyibo man say dem say "come".

Na so compiler sef dey do, if we write our ABCD123 finish, compiler go change am to "01000001 01000010 01000011 01000100 00110001 00110010 00110011" wey computer go fit understand, you see say dat number no make sense to read or write, na the wahala wey compiler dey comot for us be that

So now wey we don know wetin programming and programming language be, I know say you fit dey wonda say which programming language you go learn.

na which programming language you go learn?

Before you go choose programming language wey you wan learn, you first ask urself

  • wetin you wan do?
  • wetin you wan build?
  • shey na website?
  • shey na game?
  • shey na app wey go dey inside phone?
  • shey na app wey go dey inside laptop?
  • shey na robot you wan build?

Na wen you don know wetin you wan do na dat time you go choose language wey you go learn.

Wetin dey dere be say, all dis programming language resemble, but e get where dem for beta pass dem sef.

Why e good make you sabi programming

Why e good make you sabi programming be say,

  • You fit build anything wey you like.
  • you fit dey anywhere dey do the work.
  • you fit dey anywhere dey follow oyibo dey work.
  • money dey inside am well well.
  • you fit even use am start your small business.

Plenty plenty reason dey, but I no go fit mention dem finish.

Lass Lass

So for 2day tori, we don sabi wetin programming with programming language be, and how e take dey work.

If e get wetin you wan make I talk about, put am for comment make I know.